E be like say I go stop to take My Usual

News Express |7th Sep 2021 | 933
E be like say I go stop to take My Usual



Dis our taxi driver work get as e be. Price of everyting for market don jump up like frog wey snake dey pursue.

Garri, meat, yam, ororo, maggie, epo, plus including salt, all don increase for price.

Ordinary pure water sef, na di same di same. Dis na water wey be say Eledumare give us free o.

Even petrol and engine oil wey we dey take do our work and spare parts, all don become gold.

Money wey I been dey give my wife Bose to take maintain house for one month teletele, now dat same money no fit last one week. Tori Olorun!

Na im make e dey pain me say, passenger go come our garage wey dey near Ikeja under bridge, our stop me for road, if you tell am di money for drop or charter, e go begin price like woman wey dey price pepper for market.

Di ting wey come pain me well well be say, yesterday I carry one passenger like dat go drop for Ikoyi. As I drop am finish, I come see say time don nack 5 o'clock pm in di evening.

Na dat time babanla Go Slow dey do shege for road if you dey come mainland.

I come talk am for my mind say, if I say make I drive dey come by dat time, na im be say di petrol wey I jus buy go finish patapata for tank.

Anoder ting be say, if I say make I enter road,by di time I reach Ikeja, e go don late well well and Madam Shine Buka go don close.

Na im I chuk head put for one joint like dat wey dey for Obalende. Una kukuma sabi say dem no dey sleep for Obalende. Na di capital of area boys dem be dat.

(To be continued)

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Monday, October 13, 2025 9:18 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025