As Philo see say na me come open di front door, e shock well well.
Na so e begin stammer: “A-h-h, Ba-ba-ba Bisssi. You nn-nn-no-o-o g-g-go g-a-a-arage today?” I jus tell am yes.
But as Philo wan come inside di parlour, e use style take im nyash brush my kini wey don kukuma stand paparapa like Standard Bank right from bedroom wen me and Bose wan take style do bend bend sleep, before dis woman come knock our door.
Philo ask weda na only me dey house. E ask wia my wife Bose and my two woman pikin dem dey.
As Philo dey ask me, na so all im eye chuk for my kini. E come begin dey lick im mouth wen e know say di ting don stand attention.
I turn my back to enter bedroom go comot di towel wey I tie for waist, and wear shokoto trouser atlist make e cover di ting small. Na so Philo jump up and grab me for back. Olorun Oba o!
From back, e hold my kini for hand, sote e wan comot di towel for my waist wen my wife call me for inside bedroom, “Baba Bisi na who knock for door?” Philo nearly faint.
(To be continued)
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.