Chidinma ke? No be me and you!

News Express |29th Jun 2021 | 1,087
Chidinma ke? No be me and you!



My people dey talk am say, if animal escape trap, afraid dey always catch di animal anytime e see stick wey bend small sef. And na true talk!

Since last week, I don stop to dey put my guonguoro for road for night, sake of say I dey do night work.

To drive taxi for Lagos road for night no be moi moi. Na so you go dey see orisirisi people on duty. If no be amu robber, e go be gbomo gbomo wey don change dia name to kidnapper.

If you no see ashewo for Allen Avenue, Opebi, Victoria Island, Apapa, Ojuelegba or Ikoyi, you go see olopa wey go collect all di money wey you don manage get for di night.

But yesterday, I carry one passenger go drop for Ibeju Lekki.

I drop di passenger around 3 o'clock pm in di afternoon and say make I begin dey go back to our garage wey dey near Ikeja under bridge. My broder, by 8 o'clock pm in di night, I never near Lekki Toll Gate sef. Di kind Go-slow wey dey for dat road dat yesterday evening, I never see am before.

Na wen I don manage reach Obalende, na im one yellow sisi like dat stop me. I ask am wia e dey go, e tell me make I drop am for Opebi. As e be say na my way, I tell am my price, e gree. I say make e enter. E enter for back seat.

Wen I jus climb IBB bridge, na im I see for mirror as di sisi open im hand bag, bring out clothe and begin change for inside my guonguoro.

E comot di long gown wey e wear, I see say di sisi come dey as Olorun take create am. E no wear anyting for under – no bra, no dross, noting! Tori Olorun!

I come talk am for my mind say weda dis sisi wan make I miss road, drive enter for Lagoon.

E put di clothe wey e remove inside di handbag. E first wear one kind wicked short skirt wey be say, if e carry leg up small, you go see yonder. Den, e come begin wear body hug wey make im two headlamp tanda paparapa for im chest like Standard Bank.

Na dat time I know di kind passenger wey I carry. Olorun Oba o!

(To be continued)

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Monday, October 13, 2025 3:06 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025