Before my wife begin tell me di tori for dat midnight nko?
As e wake me up finish, e say make we no lie down, make we siddon for bed. I obey.
Instead make e talk, e begin look my face ti-ti-ti-ti. E no know say, even as sleep still dey chuk me for eye, I take corner eye see am.
Di next ting be say, Bose stand up, enter parlour wia our two woman pikin dem – Bisi and Funke – dey sleep. My wife bring back water for inside cup plus including wash hand basin.
E give me di basin make I hold, e say e wan use di water for cup take wash my face. E say becos di way e see me, sleep never comot for my eye. And di ting wey e wan tell me dey very important, make I no come dey sleep wen e dey tell me.
As I dey hold di basin with di two both of my hand, na so my wife begin wash my face inside di basin with di cup water. Tori Olorun!
After dat, na im my wife come siddon begin dey talk.
E first tank me for how I dey take care of di family even wen Coro come last year. E say sebi I know say no be im fault say e no dey bring anyting, say na me no gree am do dat oyibo work. I cough small.
E say but no be dat work matter e wan bring back dat night, but na anoder very important ting.
E call me, “Baba Bisi”.
I answer am, “Yes, Mama Bisi”.
E ask me, “Shey you still love me?”
I say, “You be my only wife and na you born my pikin dem. You know well well say I love you.”
I tell Bose make e go straight to di point, say day never break, we still dey for midnight.
(To be continued)
Make we jam again on Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.