Helep! My wife Bose don start anoder wahala

News Express |15th Jun 2021 | 1,168
Helep! My wife Bose don start anoder wahala



Di mama of my two woman pikin dem – Bisi and Funke – don come again with anoder troublem o.

Shey una remember di order time wey my wife Bose tell me say e wan start oyibo work?

Bose say di work na for casino wey oyibo man dem dey use machine play kalokalo, and na only night duty e go dey work. Tori Olorun!

Jus imagine, my wife go dey go work every night for casino wey oyibo people dey drink, smoke and play kalokalo every night till day break! If na you, you go gree?

Di ting wan bring wahala dat time becos I tell my wife say over my dead body! Di ting wey e talk dat time be say, e dey pity me as only me dey bring money for everyting for house - food o, house rent o, pikin dem school fees o, clothe and shoes for di hole family o, plus all di orisirisi tings we need.

I tell Bose say, instead make I allow am do dat kind work, I go double di money wey I dey give am every week to take maintain house.

Me sef come dey buy anyting wey I see for road, put for my guonguoro and come deliver for house – yam o, garri o, onions o, meat o, etc etc.

I try gan until last year wey Coro come show face for Naija. But even with Coro, I still dey try. You sef tink am nau, shey e easy?

Na so me and Bose take settle dat night duty oyibo work matter dat time.

Yesterday, na im my wife wake me up for midnight. E say e get wetin e wan discus with me. I come dey beg am make e allow day break, becos if I no sleep well, e fit affect me wen I dey for steering in di curse of my duty (Olorumaje!)

Bose tell me say wetin e wan make we discus dey very important, and if we wait till morning, na so I go jump up begin dey go our garage wey dey near Ikeja under bridge. And before e see me again, na night wen I come back and I go don tire finish.

E say we must to discus di matter dat night, weda or wedan’t I like am. Olorun Oba o!

With my sleep eye, I tell am oya, make e begin tell me wetin dey im mind.

Na so my wife begin nack me di kind tori wey fit make di son of man jump inside lagoon.

(To be continued)

Make we jam again on Friday

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Monday, October 13, 2025 3:05 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025