I try make I push dis madam extra, extra nyansh inside di passenger seat for back of my guonguoro, na lie.
I come dey sweat like Xmas goat. Na im I comot my jumper, wear only my shokoto trouser. I talk am for my mind say I must carry dis woman trailer today, weda or wedan't di devil like am.
Una kukuma sabi say I first no wan carry am becos of im Micheline size, make e no come dabaru my guonguoro wey I dey carry jeje like egg.
Na im make wen di madam first stop me for Moshalashi Alhaja bus stop for Agege, I say make I take high price pursue am. I tell am one high price like dat, e say e go pay. I increase di price, e say e go pay. I increase di price again, di madam still gree to pay.
You sef tink am, di money wey di madam wan pay make I go drop am for Obalende no be small money. E pass to carry passenger for drop from Lagos go Ore. Shey dat one na small money?
Na di ting wey give me inspiration be dat, na im make I use all my power to push di madam extra, extra nyansh enter di back seat.
As I dey sweat dey push, madam dey tell me "Push harder nau. Shey you no sabi push?" No wonder no taxi driver wan carry am for dat place wen e don tanda tire. No wonder e ready to pay me any amount go Obalende.
I don nearly succeed to push di madam nyansh inside wen I hear a loud sound Poooo! Poooo!! Poooo!!! Madam don mess for my mouth be dat. Imagine di kind mess wey go comot for dat kind trailer woman nyash.Tori Olorun!
Na so di ting push me and I fall down for dat main road yakata! My head nearly scatter for di tar road. Bomb blast sef na small ting. Olorun Oba o!
Na so everybody for di bus stop come dey pity me. Dem carry me up. Trust Lagos people nau, e no reach one second everywia don full. People wan come look di kind nyansh wey cause dat kind earthquake for Agege.
Dem buy pure water dey pour me for head. I drink some of di water and use some wash my face. Na dat time I come get my body small.
Di madam come say make I beg di people to helep me push im nyansh inside di back seat. Hmm, di kind eye wey I take look am go give small pikin confulsion.
People come dey curse di madam. Dem call am wicked woman. Na so all di agbero wey dey for dat bus stop helep bring down di madam. Trust agbero dem, some hold am for nyansh, some embreast am as dem dey carry am. Some sef dey do mouth to mouth. Wetin concern me?
As dem jus pull di woman trailer down, I start my guonguoro, begin go our garage wey dey near Ikeja under bridge. Olorun modupe lowo yin o!
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.