As we fall yakata, me, aboki and im okada still dey for ground for dat tarred road for Alausa wen fire begin burn di okada. And my shokoto trouser still dey inside okada spoke. Olorun Oba o!
Na so people come begin pour water for di okada and our body. Di aboki manage jump comot, me and di okada still dey for ground. Na so I come dey shout, Helep! Helep o!! Heeeeelepp me ooo!!!
People manage use water to quench di fire before somebody come comot di ear of my shokoto wey di okada spoke hold.
I stop anoder okada, na aboki too. I say make e carry me go First Gate spare parts market.
As I climb di okada, we no even reach dat main road wen olopa task force stop di okada. Olopa wan carry di okada put inside dia van but di aboki come dey struggle with olopa dem.
Na so olopa give di aboki one dirty slap for eye ppuuaaarrrhhh! Di aboki begin shout. E rush open di seat of im okada and bring out one red dagger. E wan stab di olopa for neck, but di olopa dodge. Di next ting be say, I hear pooaarrhh! Olopa don shoot aboki be dat. Blood come dey rush comot for aboki leg wey olopa shoot.
Small time, all di aboki wey dey do okada work for di area run come for dia. Dem begin fight olopa dem. War don start be dat o.
Olopa dey shoot gun, aboki dem dey pursue olopa with dagger and short gun. No do, no do, I count like five dead body for ground. I never see dat kind ting before.
I begin run with my leg, dey go Agidingbi side. And na so bullet dey fly pass my ear fia, fia, fia! Olorun maje!
As Ii dey nack una dis tori so, my guonguoro still dey for road side for Alausa since dat sallah day.
Abeg, who go helep me go bring my guonguoro come for me?
Make we jam again on Friday.
Tank you.
Tank you very much.
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.