I hear nwi for Sallah day

News Express |14th May 2021 | 1,093
I hear nwi for Sallah day



I no go ever forgot dat Thursday wey be odun. Since I begin do dis my taxi driver work, I never see dat kind ting before for dis Lagos.

To say I know say dat kind ting go happen, I for no put my guonguoro for road dat sallah day, I for dey for house with my family.

Na around 10 o'clock a.m. in di morning dat day I say make I enter road to see weda I go fit do small work. And I sabi say plenty people go go pray for mosque for sallah day, and many of dem go wan use taxi.

True true, as I drive comot for my house wey dey Abule Egba, I no even reach Pen Cinema wey one family like dat stop me. Dem say make I carry dem go drop for central mosque for Alausa, Ikeja.

Na one man like dat wey im bie bie nearly long pass Osama own na im stop me. Di man dey with im two wives plus including dia small pikin dem.

I tell di man my price, e gree. I say make dem enter. Na so I go drop dem for Alausa mosque.

As dem come down, I put my guonguoro for revise, den turn and begin face Agidingbi.

I jus wan pass Femi Kuti shrine wen anoder passenger stop me. E say make I go drop am for Alapere, Ketu. I tell am my price, di man gree. I say make e enter.

As we jus move small, I hear one kind noise for under my guonguoro pprruuaahh! I park and come down. Come see my tyre bend go one side. My tyrod don kpafuka be dat. Tori Olorun!

I tell di passenger make e come down and find anoder taxi.

As e come down, I wind up all my glass window and lock di door. I stop one okada make e take me go for dat spare parts market for First Gate.

Di okada man na one small Aboki like dat. I siddon for di okada, as di aboki jus move small, na so my shokoto trouser enter okada spoke, and na so di two both of us land for ground yakata! For dat tarred road o!

(To be continued)

Make we jam again on Friday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Monday, October 13, 2025 4:57 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025