See wetin Pantami cause inside my guonguoro

News Express |4th May 2021 | 1,206
See wetin Pantami cause inside my guonguoro



I dey enjoy dis my taxi driver work, no be small.

I no sure say I fit do any order work, even if dem ready to pay me one million naira.

Yes nau. I don learn plenty tings for inside dis work since wen I begin drive tipe tipe, even before Biafra war show face.

Dis work don make me sabi plenty tings and na so I dey learn every day becos na orisirisi tings dey happen for Lagos road. And na orisirisi passenger dem I dey carry, and na orisirisi tori I go dey hear for dia mouth.

Di kind words wey I dey hear for my passenger dem mouth, e get as e be. Before na gbomo gbomo we dey hear. But now na kidnappers, terrorists, bandits and herdsmen we dey hear everywia.

Anoder one wey dem dey talk now na Pantami. I no know weda na person name abi na spirit. Di ting dey cause wahala now, no be small. Everywia you go, na so so Pantami you go hear.

See like di order day wen I carry two bobo dem go drop for one hotel like dat for Isolo. Na wen dem begin talk as we dey go for road, na im I sabi say na Yahoo boys I carry for my guonguoro. And na Pantami dem come dey talk.

Yahoo Boy1: Dis man na very wicked person. Why di man wan come choke our business?

Yahoo Boy2: Who wan choke our business?

Yahoo Boy1: Na dat terrorist wey dem dey call Pantami.

Yahoo Boy2: Aaaah, dat man na better person o. No mind wetin dem dey talk about am.

Yahoo Boy1: How confirm terrorist take be better person? You no hear say di bobo wan make tings hard for dis our business?

Yahoo Boy2: How?

Yahoo Boy1: Na im bring NIN. Now I hear say e wan connect NIN to SIM, after dat e go drop BVN and PVC make we dey use only NIN.

Yahoo Boy2: Dat na better plan nau. E go helep dis our business wella.

Yahoo Boy1: Na becos of di way you dey talk make me dey always tell you say lai lai you no fit succeed for dis business. Better go find anoder work do. You and mugu dem na di same mama born una. Na im make you no fit catch any mugu make e drop better pay since you start dis business. See di only oyibo wey we don nearly catch di order day, you let am go becos of say your brain dey leak.

Yahoo Boy2: Bros, why you dey insult me nau

Yahoo Boy1: How I no go insult you wen you no dey tink well? How you go talk say wetin Pantami wan do good for our business? You no know say di man get im agenda? If e succeed with NIN, shey you no know say we no get business again? Apart from dat, di man wan use NIN connect all im broda dem for Chad, Niger and Senegal make dem dey use style come vote for dia people for any election. By dat time, dem go don drive all of us comot for Naija. Tink straight maaan! Make use of your brain!! You be original M.U.M.U

Yahoo Boy2: Who? Me?

Na so I hear puuaarrhh! Dem don give person dirty slap for face be dat o. Come see fight for inside my guonguoro becos of Pantami.

Na so I match break fiiaaaaam, and park for road side. I come down and open di back door. I tell dem to come down. E come be like say na dat time di fight come strong pass.

Dat very time, na im olopa motor one pass. Olopa wey hold gun full for inside di motor. I stop di olopa motor.

As olopa dem come down, I tell olopa say I get two customer for dem. I tell di olopa say na Yahoo Boys dey inside my guonguoro so.

Una kukuma know say olopa dem no dey wan take ear hear anyting Yahoo boys dem. Na so olopa point gun for di Yahoo boys dem head, and order dem to come down kia kia. Dem begin search dem

I enter my pilot seat, close door, start my engine and begin go my way.

Pantami ko, Pantima ni. Mtcheewwww!!!

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Monday, October 13, 2025 7:09 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025