As Naija dey now, anybody wey no wan upgrade, go jus remain wia e dey.
Na im make you see say tailor no dey again, na fashion designer full everywia.
Shoemaker now na cobbler. Carpenter don become furniture designer, and so on and so forth.
Na yesterday my passenger talk sense gan put for my head. Di bobo na my customer tipe tipe but I no come dey see am again for some time.
Before before, di bobo go jus call me for phone, say make I come carry am for im house for Anifowoshe, go somewia. And e been dey pay me better money dat time.
But since wen Bolt and Uber dem come, I no dey see di bobo again. I even tink say e don go back to im state, Ebonyi.
And I no come get im number again becos of so, so change of phone every time.
Dat yesterday, around 12 o'clock p.m in di afternoon, I dey for garage as passenger no show face since morning. In fact, no be only me. All our union member dem complete for our garage wey dey near Ikeja under bridge.
As I siddon dey look road, I see one bobo nack jacket on top of jeans trouser. E wear white canvas, den come use tie for neck.
Di bobo come resemble person wey I know. I look am ti-ti-ti-ti, den come remember say na dat my old customer.
But di bobo don upgrade gan.
Dat time di bobo don waka reach Ipodo side. Na im I run go meet am. I call am Nnamdi! Nnamdi!! E stop. Nnamdi surprise to see me. E come call my name "Oga MAT"!
I ask am wia e dey go, e say e wan enter one shop after Ipodo and buy someting before e take Uber go Alausa.
I tell am say which kind Uber wen my guonguoro dey. I say make e tanda wait for me for dia, make I rush go bring my guonguoro for garage come carry am.
Nnamdi call me back. E ask me weda I still get im phone number. I tell am no. E say make I bring out my phone. Na so I bring out my torch light chinko phone. I use corner eye see say Nnamdi wan laugh but e manage hold di laugh.
E say make I take im number. E begin call di number for me, and I save di number.
E say make I call am any time I change my guonguoro to Uber, and wen I change am, e go dey use me everyday. E ask me how I expect am, as e don upgrade so, to still dey enter my yellow taxi.
Na so Nnamdi waka lef me for dia o. Olorun Oba o!
My broda, shame nearly kill me die.
Na im make I say, before dis year pass, I must to upgrade to Uber.
Lagbara Olorun!
Make we jam again on Tuesday
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.