Dis our taxi driver work don dey tire person. Every day, person dey see orisirisi tings.
Now, to service my guonguoro cost like wetin dem dey take service aeroplane tele tele. And spare parts don cost pass gold sef.
Di one wey come bad pass na as petrol price don dey dance konkoma. If you go petrol station for Agege, na different price you go buy petrol. Drive go Ikeja, na anoder price. For Ikoyi, VI, Lekki and VGC, na different price dem go sell am for you.
Dem even talk say for Kano, Ibadan, Akwa Ibom, Abuja, Benin, Borno, Port Harcourt, and order town dem for Naija, to buy petrol cost pass to marry Owerri sisi. And na di same contry we dey o.
If na price be di only troublem, person for dey manage, but plenty tings don come join.
Di order day wen I carry passenger go drop for Mafoluku near airport, I see say my petrol guage don dey show red. Na im I say wen my passenger come down, I go enter dat petrol station wey dey before dat overhead bridge for airport road, buy full tank wey go reach me like four days. Dat is, if Go-slow go allow o.
As I drop my passenger, I revise, den begin face di petrol station. As all dose attendant see me drive into dia station, come see as dem rush me. But na di pump wey one tall, yellow sisi dey, na im I drive go meet.
As di yellow sisi see me, e smile, den dobale greet me. I come talk am for my mind say dis smile no be free o, na my change e dey target so.
Before I open door come down sef, di sisi don already open my petrol tank. E ask me how much, I tell am fill up.
But as di yellow sisi wan put di pump inside my tank, I check my pocket, come see say na only N1,000, plus including di N2,000 wey dat my passenger pay me, dey my pocket. I don forgot say no be di shokoto wey money dey I wear comot for house dat morning.
I quick quick tell di yellow sisi make e sell only N2,000 petrol, say I don forgot say I no bring my ATM. At least make N1,000 remain for my pocket in case of incasity. Di yellow sisi come look my face one kind. E no come smile again.
As di yellow sisi sell di petrol finish, na me come close my tank. Di yellow sisi no come cooperate again. Wetin concern me?
I enter my pilot seat, close di door, put my guonguoro for gear, and drive comot for di petrol station.
I no reach Oshodi Oke wen my guonguoro begin shake like Shakespeare. I no come know wetin happen.
I say if I stop now, all dis LASTMA wey full for dia go come block me, and dat one na big wahala be dat.
I come manage dey go small small till I enter service lane. I clear for road, and park.
Shebi una kukuma remember say na mecho apprentice I first be wen I run come Lagos before I become taxi driver.
I go down, open bonnet and check di engine. I no see anyting. I carry footmat for inside, put am for ground, lie down for di footmat and check under, I no see anyting.
I go back to bonnet and check oil, di oil guage. So na wetin come happen? I say today na today. Abi na bad petrol I buy for dat station?
I go inside again, open ignition to start di engine, na lie! Di engine no gree kick again. My eye go for petrol guage. I see say di guage don enter red again. Tori Olorun!
(To be continued)
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.