I give Sikiratu Red Card for Easter

News Express |6th Apr 2021 | 1,169
I give Sikiratu Red Card for Easter

If you trust anybody for dis world, you jus dey deceive yoursef.

Di only person I been trust for dis world, na my mama wey born me. But my mama don peme since, before I even run comot for my village for Ogbomoso, come Lagos becos of Arike papa.

Na one day wen I go Madam Shine Buka wey dey near Airport Hotel to take My Usual in di evening, na im I see one girl wey serve me well well. Dis tori wey I nack una so don tey o, no be today matter.

As I finish wan go, I pay di buka girl and e give me change, but I say make e take di change. Di buka girl kneel down and tank me.

Di second day wey I go dia, na so di buka girl serve me again, and I dash am change again.

Na so di ting continue. Na im make, anytime di buka girl see me enter, e go make sure say na im serve me by imsef, e no go allow any order buka girl serve me. Na so we come begin like oursef small small.

One day I ask am im name, e smile, look ground and begin use im right leg dey draw someting for ground, before e look up, smile again and come use bedroom voice tell me say, “My name na Sikiratu. But you fit call me Siki Baby”.

Me sef tell am say my business name na Man About Town but everybody dey call me Oga MAT. E ask me which kind business I dey do, I tell am say I be taxi driver and our garage dey near Ikeja under bridge.

Since dat time, me and Sikiratu come become bread and butter sote im oga, Madam Shine, come know say me and Sikiratu dey kamkpe. Even all our union member dem for our garage know.

And dis Sikiratu fine no be small. If e package im body like dis come out, you go tink say e been study packaging science for university, you no go know say na buka girl.

Na so im two paw paw tanda for im chest like Standard Bank, and im boysquarter na who-send-you-come. No man wey see Sikiratu wey no go swallow saliva.

Sikiratu love me, and I love am. But if I tell you say me and my Siki Babe never do till today, you go believe? If we don do, make I baf naked for bafroom.

Di only ting be say, Sikiratu do wetin make me give am red card dis Easter. I no sure say I go forgive am.

(To be continued)

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Monday, October 13, 2025 9:26 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025