I don tire for Lagos roads, I swear!

News Express |16th Mar 2021 | 1,282
I don tire for Lagos roads, I swear!

If no be say person don dagba finish, I for don change dis my taxi driver work.

I don dey do dis work for Lagos since before Biafra war, but di kind tings wey dem dey do for Lagos roads now don tire me.

Passenger no kukuma dey like before becos of all di orisirisi transport wey don show face - BRT, Uber, Bolt etc, etc.

And di only passenger wey we dey manage get, Go slow wey dey for road no dey allow motor waka.

I no know wetin dey for Ikorodu Road wey make gofmen dey repair am every day - from January to December – especially wen rain don begin dey fall.

Night day o, but na for day time dem dey always repair di road make people see say gofmen dey work.

Since last week, Ikorodu Road na no-go area. And wen e happen like dat, na im be say all di road for Lagos don follow block patapata.

See like last week, one madam come our garage wey dey near Ikeja under bridge. Di madam say make I go drop am for Yaba, say e dey go for seminar and e no wan late na im make e come early by 7 o'clock a.m. in di morning. E say di seminar go start by 10.

I tell di madam say no wahala at all at all, say to get to Yaba from our garage go be patapata 40 minutes.

Na so we begin dey go o. I chuk head put for Alausa Secretariat, to go burst out for 7up, den to Ojoto. But my broda, as we jus reach 7up, di kind Go-slow wey dey dia, I never see am since I begin do taxi driver work for Lagos.

I manage revise for dat express, say make we go take Oregun and enter Ojota, I no know say dat one na im be di woss. Tori Olorun!

Na so we dey inside Go-slow, dey sweat, Ojota sef we no reach.

I look time, 9 o'clock a.m. don nack. My passenger wan cry. I come dey try to cool im temper. I tell am say road go clear wen we jus pass Ojoto bus stop and enter Ikorodu Road.

As we manage enter Ikorodu Road for Ojota, na dat one come bad pass. I see say out of 8 lanes wey dey go Yaba and Ojuelegba, dem squeeze out jus half lane for all di motor to pass. Olorun Oba o!

Na for dat same spot we tanda, some people switch off dia motor engine, some motor sef peme becos of overheat.

Na so dem come dey pass motor one by one for express o.

By di time we reach di head of dat Ojota bridge wey di road open, time for seminar don reach.

And by di time we reach di place dem dey do di seminar for Yaba, seminar don finish. My passenger jus faint.

Na one bag of pure water wey I buy kia kia, order people come join me to pour di madam for body before e wake up.

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Monday, October 13, 2025 11:44 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025