See me, see kidnapper dem

News Express |23rd Feb 2021 | 1,115
See me, see kidnapper dem

Na only Eledumare dey save us for dis taxi driver work, if no be so, di son of man for don peme tipe tipe.

No type of passenger wey dis my guonguoro never carry – Profs o, teachers o, politricktians o, Yahoo Yahoo o, amu robber o, olopa o, soja o, business people o, students o, ashewo o, pastors o, imam o, babalawo o, In short, na orisirisi passenger dem I don carry.

Na im make some people dey talk say na ashewo work we dey do. Yes nau. Ashewo work, anybody wey show face na customer, even if na mad man.

See like di order day, OC Crime for Ikeja station come meet me for our garage wey dey near Ikeja under bridge.

OC Crime na my paddy paddy. We dey jam for Madam Shine buka wey dey near Airport Hotel every time, dat same buka wey Sikiratu dey work.

Dat day, OC Crime waka come garage. He come with three order olopa wey dey work with am. And all of dem carry gun. But dem no wear uniform.

OC Crime say make I quick quick carry dem go Dopemu. Before e talk am finish sef, e

don open front door of my guonguoro and enter. Na so im boys enter for back seat too.

OC Crime sabi wetin dey my mind, e say make I no worry, say e go pay me wen we come back. I ask am weda na to go drop dem for Dopemu and come back, or na charter, which means say I go wait and carry dem back.

OC Crime say I go wait for dem. I say no troublem. I tell am my price per hour, e gree.

Na so I jump inside pilot seat, open ignition, start engine and put am for gear one. We don dey go Dopemu be dat.

(To be continued)

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Tuesday, October 14, 2025 1:55 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025