As I jus drive enter our garage wey dey near Ikeja under bridge, na im my torch light chinko phone ring again. I check am, I see say na my landlord, Baba Braimoh dey call again.
I say shiooorr, shey dis man don become monitoring spirit? Na wetin be im troublem gan?
I say make I pick, weda apart from di meeting wey im don fix for dis evening, anoder ting dey. Na so di line cut. So na flash dis man dey flash me again? Na wa o!
I park my guonguoro and come down, our union chairman, Jimoh ask me wetin dey do me wey make my face squeeze like oyibo wey dem give agbo drink. Jimoh ask me weda na di heavy Go-slow wey e hear say dey for road dat morning make me vex.
I just tell Jimoh say no wahala. Na im I go siddon for bench, say make I relax small. I look time, na 11 o'clock am in di morning.
I come dey look weda anoder passenger go show face again, at least make e be say I don carry two passenger for dat day, before evening wey I go begin go Baba Braimoh meeting for house wey dey Abule Egba.
Na so my landlord begin flash again. Shebi dis man don flash me tele tele wen I go drop passenger for Maza Maza? Wen I park for road side dat time and call am back, e tell me say make I come back quick for evening, say e wan meet all di tenants. We still dey for morning now, wetin for make am come dey flash me again?
I come talk am for my mind say abi someting serious don happen for house?
I remember say my wife, Bose tell me say later dat morning, im and our second woman pikin Funke go go dia church wey dey for Pen Cinema for morning fellowship, which mean say na only our first pikin, Bisi go dey house by dat time.
Shey someting happen to Bisi wey make Baba Braimoh come dey flash me again after we don talk? But if someting happen, Bisi get im own phone nau. Abi di ting wey happen dey so serious sote my pikin no fit call?
Afraid come dey catch me. I say make I call Baba Braimoh back. I call, and e pick am. I ask my landlord why e come dey flash me again.
Baba Braimoh come talk say e jus wan tell me say make I no late for di meeting. Tori Olorun!
I no know weda make I throw dis my torch light chinko phone from Ikeja, make e go nack Baba Braimoh head for Abule Egba.
(To be continued)
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.