Na wa for Lagos landlord dem o!

News Express |2nd Feb 2021 | 1,303
Na wa for Lagos landlord dem o!

For dis Lagos wey we dey so, if you tink say anybody dey your side, na O.Y.O you dey.

Na we taxi driver dey see pass.

Before you see any LASMTMA, Yello Fever, Maja Maja, VIO or Road Safety smile and greet any taxi driver, make you know say dat driver dey drop gan. Di driver na dia ATM.

If no be so, all of dose uniform people go dey stop di taxi driver for road per second per second. And di driver go show Particulars tire.

Dat one na small ting sef. Lagos landlord wahala na im worss pass. Lagos landlord dem be like Coro, dem no dey hear abeg.

Na so I carry passenger for drop go Maza Maza di order day. Una kukuma sabi as dat road be. I jus dey dodge potholes upadan na im my torch light chinko phone begin ring grriinnn, grriinnn, grriinnn!!! I beg my passenger make I park for roadside answer di call.

I check, I see say na my landlord Baba Braimoh dey call me. I wan pick di call, na im di ting cut.

I start engine again to move, na im di phone ring again, and na Baba Braimoh again. I wan pick, again, na so di ting cut again. Na dat time I know say na flash my landlord dey flash me. Olorun sanu mi o!

I come talk am for my mind say, why dis man go dey flash me like dis? I no owe am rent, I no owe NEPA, I no owe for security and dirty. And no be say na call o. Na flash e dey flash. Olorun Oba o!

I say make I know wetin dey happen, na im I call am back. E ask me wia I dey. I tell am say I dey work. My landlord begin hala for me.

E say e been come knock my door early dis morning, my wife tell am say I don comot. E say im come dey wonder why I go comot dat kind early morning. E say e come dey suspect say I dey inside house but I no wan see am. Na im make e say make e call me to dey sure say I no dey hide for am. Tori Olorun!

I ask Baba Braimoh weda e fix any time for me to dey go my work. E say no. I ask am weda me and im get any appointment. E say no. I ask am weda I dey owe am house rent or NEPA bill, security and money for dirty. E say no. I ask am say, so why I go dey hide for am?

Baba Braimoh say weda na dat small ting wey im tell me dey vex me. E say, di ting be say, e been wan make we do landlord and tenants meeting dat early morning before anybody comot for house. But as e be say I don already comot, make I come back early for evening dat day. E say e get important ting wey e wan tell all di tenant.

Dis man again? E no dey tire? All dis meeting meeting, na becos of dis face-me-I-face-you house wey dey inside Abule Egba o. If na duplex or ordinary flat for Banana Island nko? Na im be say e for dey call tenants for meeting every hour.

I tell my passenger make e no vex as I delay am take dey answer call. Di bobo say make I no worry, say na di correct ting I do so, to park and answer call.

As I go drop my passenger for Maza Maza, den come begin go back to our garage wey dey near Ikeja under bridge, I jus dey tink wetin Baba Braimoh wan talk dis time.

(To be continued)

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.



Comments

Post Comment

Tuesday, October 14, 2025 1:55 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025