My pikin wan marry Aboki

News Express |29th Jan 2021 | 1,468
My pikin wan marry Aboki

For dis life, e be like say di ting wey person wan make e happen, e no dey quick happen. But na wetin person no like, na im dey happen kia kia.

Tuesday last week, I don reach our garage wey dey near Ikeja under bridge before I remember say I been comot my spare tyre for boot wen I dey wash my guonguoro dat morning for house.

Quick, quick, I begin go back to di house wey dey for Abule Egba.

As I enter our street, I see cows full everywia. Di cows no even let me pass, dem block road patapata. Na wen I blow horn puom, puom, puom, na im di aboki wey waka with di cows use stick tell di cows make dem comot for road make I pass.

I come remember say one bush dey for di back of dat our street, na im di aboki dey carry im cows go make dem chop. Na around 9 O’clock am in di morning dat ting happen dat day.

Di next day, I carry one passenger for our garage wey dey near Ikeja under bridge. Di passenger tell me say make I drop am for Abule Egba. I ask am which side for Abule Egba. Di bobo come mention di street wey dey for di back of our house after dat bush wey aboki carry im cows go last week.

Di same way e happen dat first day, cows don block di road. I horn again puom, puom, puom, before di aboki use im stick clear road for me and my passenger.

I look time, I see say na 9 O’clock am in di morning, same time, same place wey I see di aboki and im cows dat first day.

Yesterday, I say make I rest for house small till 12 o'clock pm in di afternoon before I put my guonguoro for road.

My wife Bose go market, na me and my two woman pikin dem – Bisi and Funke - come remain for house.

Around 10 o'clock am in di morning dat yesterday na im I stand up for bed. I call Bisi and tell am say make im and im sister Funke begin go wash di guonguoro as time don dey go.

Na dat time Bisi tell me say im small sister don comot. I as am wia Funke go, e say e carry ice water go give person. As Bisi dey tell me, na im Funke jus appear.

I ask am wia e go, e say e go dia (e dey point hand for di back of our street). I ask am wetin e go do dia (me sef point hand for back of our street).

Funke tell me say e carry ice water go give person to drink. I ask am say, shey dat person no get name?

Na dat time Funke look ground, begin use leg to draw map for ground. Den e look up and say na im friend Mustapha e go give di ice water make e drink and calm down.

“Eh? Your friend? Mustapha?” I ask am.

Funke say na one aboki wey dey carry cow waka. E say na about dis time every morning e dey go give Mustapha ice water for inside dat bush wey dey for back of our street. Olorun Oba o!

I ask my pikin which day e begin go give Mustapha ice water for inside bush. E say since last week. I come remember say na dat last week I begin see aboki and im cows for our street. Tori Olorun!

I ask my pikin which kind friend im and Mustapha be. Funke smile small, after e come tell me say dia friend na Agape. I ask am wetin be Agape. E say dat mean say na holy friend dem dey do. But dat anyting fit happen later becos Mustapha love am and e love Mustapha. Olorun sanu mi o!

See my pikin wey I don spend money for im and im sister head to do JAMB four times now, before dem come jam JAMB last year. So, make dem dey wait di day wey JAMB go give dem University, na im my pikin don dey find Fulani herdsman go for inside bush?

I talk am for my mind say dis pikin no go kill me o. I no come know wetin to tell am.

See dis my pikin wey I dey always pray for im and im sister make dem one day see better husband marry o.

So, dis my pikin no see Otedola, Adenuga, Dangote or even Bill Gates son, Na aboki for inside bush e see? Olorunmaje!

But I get wetin dey my mind wey I must do latest by dis time tomorrow before dis girl go make me run comot for Lagos wey I don dey live since before Biafra war. And I must to do dat ting.

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Tuesday, October 14, 2025 4:43 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025