Soup wey sweet, na money kill am (2)

News Express |19th Jan 2021 | 1,283
Soup wey sweet, na money kill am (2)

As we dey go, oga say make I branch dat KFC wey dey opposite Computer Village for Ikeja. Wen I park for KFC, oga come down, e say make I wait for am.

Na so dis my passenger waka enter KFC by imsef. Wen e come out, e carry two full pack. E give me one and take one. I say make I use style open di pack and see wetin dey inside, my broda, I nearly faint.

See fried rice, potato chips, salad, one full chicken, snail, moi moi, big fish wey dem don roast, plus including Five Alive. Olorun Oba o!

I ask di oga weda e sure say e no make mistake for di pack wey e give me so. I tell am say di kind tings wey I see inside too much o. Oga say na my own pack be dat. I nearly roll for ground for dat main road to tank di oga.

Oga say make we begin dey go V/I. E open im own pack, begin chop. And na so I swallow saliva ti-ti-ti-ti. E be like say di oga dey see me for mirror. E tell me say make I get patience, say shebi I know say I no fit chop as I dey drive. E say wen we reach V/I, I go use di time wey I go wait for am, chop.

Wen we reach V/I, e say make I drive dey go Adeola Odekun. As we reach dia, e say make I drive enter one bank compound like dat.

As security man wey dey for di bank gate jus see Oga for inside my guonguoro, di security man stand attention and salute.

I park say make oga come down, na so all di security people for di bank rush come to open door make oga come down.

As oga come down, na so di head security collect oga brief case. Oga tell di head security say I go wait for am till after di board meeting. Kia kia, di head security direct me to one garage wey I go pack my guonguoro as I wait for oga. Wen I look up dat garage, I see say dem write, “Chairman Only”.

Dat time na 10 O’clock am in di morning. Oga don go up after e give me signal say make I wait for am. Me sef come relax inside my guonguoro, open my KFC pack and begin deal with am small small.

As I dey wack my ting dey go, all di security people and customer dem wey dey for outside jus dey look me, some dey swallow saliva.

(To be continued)

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.



Comments

Post Comment

Tuesday, October 14, 2025 4:51 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025