No facemask, no guonguoro

News Express |8th Jan 2021 | 1,202
No facemask, no guonguoro

Afraid don dey catch me, no be small.

Yesterday, two passenger take me for drop go Lawanson for Surulere. From di time we comot for our garage wey dey near Ikeja under bridge, na so so Coro tori dis two bobo dey nack.

Dem mention all di people wey dem know wey don peme becos of Coro since last month.

Dem mention dose wey get am but still dey take medicine.

Dem mention di ones wey di ting catch but dem manage escape to peme after treatment.

Dem mention di big oga dem wey dey inside and outside gofment. Dem mention musician and actor dem. Dem mention gofnor, minister, pastor, imam, banker dem, etc etc.

Di one wey come fear me pass, dem talk say new type of Coro don show face for Naija. And dem say dis new one no dey hear abeg. Tori Olorun!

One of di passenger even talk say Coro catch am last year but na God safe am say e no peme. Shiooorr!

If no be say we don reach Ojuelegba bridge, wey I go jus turn small, enter Itire Road den begin face Lawanson, I for tell dem to come down kia kia and even go with dia money.

Me, carry person wey don get Coro tele-tele inside my guonguoro? Olorun Oba o!

As di bobo jus talk dat ting, I open my pigeon hole, bring out my facemask and tie am for nose. I even stop to breath sef. How I sure say di Coro don comot for im body patapata?

Wen I drop dem for Lawanson, e come be say na dis same bobo wan pay for dia transport.

As di bobo dey bring out di money for im pocket, one mind say make I no collect di money, anoder mind tell me say if I no collect am and e come be say I no see anoder passenger carry dat day nko? I confuse.

Di ting wey I do be say, I bring out my handkerchief for my shokoto trouser, do like say I wan use am clean my face. I take style cover my hand with di handkerchief as di bobo give me di money.

As I jus collect di money, I no even count am to see weda or wedan’t e compete. I jus drop di money for floor carpet for passenger side.

I drive go front small, den clear and park. I bring out one full bottle of sanitiser and pour am for di money. I bring our anoder bottle and use am rob my head, neck, face, hand, leg and clothe. In short, I take am rob all my body and everywia inside my guonguoro.

Na dat very time I talk am for my mind say as from dat very day, I no go ever carry any passenger wey no wear facemask again lai lai.

I don even give one artist make e draw “No facemask, no guonguoro” wey I go paste for di body of my guonguoro. Na who wan peme?

Make we jam again on Tuesday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Tuesday, October 14, 2025 4:49 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025