Di way dem dey talk about dis Ondo 2020 matter for Lagos, e come be like say Ondo na part of Lagos.
All di passenger dem wey I dey carry since last week, na Ondo matter dem dey talk. Sote me wey no dey like to talk about Naija politricks, my passenger dem go make sure say I put mouth for di matter.
And I go dey put mouth small small, no be say I too like wetin dem dey talk, but na my money I dey target for dia hand. If any of dem say na Aketi, I say na im. If anoder one say na Jegede, I go say yes na im. Wen di passenger go down, na di end be dat. Which one concern me?
Di only ting wey concern me well well for dis Ondo 2020 matter na my wife Bose.
I jam Bose for Lagos wen I finish my mecho apprentice work. We marry and Bose don born two woman pikin for me – Bisi and Funke.
But Bose no wan take im eye comot for any Ondo matter. I dey tell am everyday say, me na Ogbomoso I be, so my wife plus including all my pikin na Ogbomoso.
But any time I talk like dat, my wife go ask me say, since I run comot for my village before Biafra war becos of Arike papa, weda my leg don enter Ogbomoso again. E go ask me weda Lagos na Ogbomoso.
Since yesterday my wife don travel go Ondo. E say e must to go and vote. Dat one no for pain me becos no be di first time. But dis time my wife no travel alone, e carry Bisi and Funke go.
Before dem go, my wife don cook orisirisi soup put for frizer wey go carry me till dem come back after next week – Efo, Ewedu, Draw, White soup, all dey for frizer.
But na who go come dey warm di soup wen be say before 6 o'clock am in di morning everyday I must comot for house dey go work?
Who go dey wash my guonguoro every morning before I go, and every night wen I come back?
Who go dey buy water for Aboki hand as water no dey for dis Baba Braimoh face-me-I-face-you house wey we dey live so for Abule Egba?
Who go wash my clothe and sweep di room and parlour wey we dey live?
Who go dey wash plate and pot wen I eat finish every night wen I come back?
And who go come dey scratch my back for me every night before I sleep?
Shey una see di kind ting wey Bose do me jus becos of dis Ondo 2020?
Na im make I need one fine sisi wey go serve me as part time wife till Bose and my two pikin dem come back after di election for Ondo.
Any sisi wey get interest for di part time work, make e show face tomorrow by 12 o’clock pm in di afternoon for our garage wey dey near Ikeja under bridge.
Make we jam again on Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.