Independence Day love

News Express |2nd Oct 2020 | 1,343
Independence Day love

All di tings wey we dey enjoy dat time wen we be small pikin no dey again.

I remember dat time for our village night school for Ogbomoso. I dey for Standard 1, come pass go Standard 2, after dat I enter Standard 3, den Standard 4 and Standard 5.

I no finish Standard 5 wen I run comot for village come Lagos becos of say Arike papa wan use African Insurance finish me say na me give Arike belle.

But anytime I remember all di small pikin play we dey play date time, e dey be me like say make I go be small pikin again for my village.

I remember ten ten, boju boju(hide and seek), suwe, bread and butter, ayo, ikosi and plenty play like dat.

But na boju boju been dey sweet pass for night. You go jus target one sisi, carry am go hide togeder for one corner make dem begin dey find una. Shey you understand?

After dat, we go wear our school uniform wey our papa don iron finish with charcoal iron, and new Bata shoe, go march for stadium on 1st October and 27th May wey dem dey call Children’s Day.

But now na so so internet small pikin dem dey do with dia phone. Dem no enjoy di orisirisi play and march past wey small pikin like dem dey enjoy dat time.

Na all dis ting I siddon yesterday, wey be 1st October, dey tink for our garage wey dey near Ikeja under bridge.

I jus hear person call me Oga MAT. E put im hand for my shoulder. I shock. I no know wen Sikiratu waka enter garage.

Di next ting be say, Sikiratu open im hand bag wey I sure say e buy for bend down boutique for Ikeja Along.

Sikiratu bring out someting give me. E don take time wrap di ting with fine paper and write on top: “Happy Independence my love”.

As Sikiratu jus give me di parcel, e put im mouth for inside my mouth, bring out im tongue inside my mouth, and di ting come make piiomm! Tori Olorun!

Na so Sikiratu say make e run back go dey do im work for Madam Shine Buka wey dey near Airport Hotel.

I come open di parcel. Come see wetin Sikiratu give me as my 1st October gift – two white dross, two white singlet and two white handkerchief. Olorun Oba o!

I come talk am for my mind say dis my Siki Babe no go take love finish me for dis Independence Day o.

I call am with my torch light chinko phone and tank am well well sha, but I sabi say na seed Sikiratu dey take style sow so for Xmas.

Make we jam again on Tuesday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.



Comments

Post Comment

Tuesday, October 14, 2025 6:45 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025