Di next ting be say, I open my eye to see mysef on top of bed. I look left, I see anoder person for bed. I look right, I see anoder person for bed.
Den I come see one long pipe wey connect my hand with one pole wey tanda near my bed. As I wan shake my hand comot for di pipe and pole, na im I hear, “No, no, no! Don’t move your body! Just relax. You are on drip!!”
One sisi like dat wey wear uniform, run come hold my hand. Na dat time I sabi say I dey for hospital bed. Olorun Oba o!
My mind come go back...
I remember di passenger wey I carry go Apapa for morning dat day.
I remember di kind ogbonge Go-slow wey dey for dat Apapa road as I go drop di passenger.
I remember as my guonguoro begin do overheat for inside di Go-slow till I manage am from Apapa go reach our garage wey dey near Ikeja under bridge.
I remember as I pack my guonguoro make di overheat come down make me sef relax and take breeze.
I remember as one bobo like dat wey get bie bie like Osama, waka come meet me and begin ask weda na me be Oga MAT.
I remember as e hug me and shout say I be im papa, and e come from Ogbomoso wey me sef come from.
I remember di talk about Arike – as me and Arike dey siddon togeder for Standard 5 for our village night school until Arike come carry belle.
Den, I come remember as di bobo tell me say na im be dat belle.
I no come remember any order ting till I see mysef so for hospital. Tori Olorun!
I wan talk, I no fit open my mouth. Small cough worry me, as I cough, I come dey feel pain for all my nyansh. Na dat time I know say nurse go don use injection play basketball for my nyansh.
As I manage cough, di nurse come use im soft hand dey rob me for my chest, e touch my neck to see weda my body hot. Den e come smile and tell me, “E pele sir. You will be fine soon.”
I ask di nurse wetin do me and who bring me come here. As di nurse wan begin talk, na im my wife Bose and my two woman pikin – Bisi and Funke enter.
And na so Jimoh our branch chairman, enter with all our union executive dem – Idowu (Treasurer), Akpan (Social Organiser), Emeka (Provost) and Mutiu (Financial Secretary).
Di next person wey enter na dat bie bie bobo wey tell me for garage say na im be di pikin wey Arike born for me for our village for Ogbomoso.
Dat very time, I jus dey hear small small like say I dey dream as di nurse shout, “Doctor, doctor! He has fainted again!!”
(To be continued)
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.