Abeg how I go take handle dis matter? Tomorrow na Sikiratu birthday

News Express |25th Aug 2020 | 1,454
Abeg how I go take handle dis matter? Tomorrow na Sikiratu birthday

Sinceyesterday wen Sikiratu come meet me for our garage wey dey near Ikeja under bridge, my life no be di same again.

All my mind, brain, mouth, nose, hand, leg, ear, head and even my kini, all dey tink of Sikiratu now.See as dis small pikin don come put agbalagba like me for high jump. Tori Olorun!

Dat yesterday, Sikiratu come tell me say tomorrow wey dey come so, na im birthday. I tell am happy birthday for advance.

Sikiratu tell me, “Tank you Oga MAT”. Den e come tell me say, but no be only “Happy birthday” e wan from me.

I come ask am wetin again e wan for my hand.

E come ask me say, sebi I know say na me, Oga MAT, be di only person wey e get for dis Lagos. I say I know.

E say sebi I know say I be di only man for im life. I say I know.

E say make I search am inside out, turn am upside down, I no go hear say e get any order darling for dis world apart from me. I say I know.

I come tell Sikiratu make e forgot all dis sermon and go straight to di point. I ask am wetin e wan from me.

Sikiratu say sebi I know say since wen we begin do dis our lovi lovi, I never touch am well well, as Madam Shine no dey gree give am off duty for dia beer parlour/pepper soup joint.

E say becos of im birthday, Madam Shine don give am off dat day. Sikiratu say e wan make we stay, enjoy and sleep togeder TDB for im birthday. I say shiooorr!

Sikiratu say dis one no be shiooorr matter. E say I must make am feel like woman for im birthday.

I no even tink dat one finish, Sikiratu bring out one paper wey dey im handbag, and give me. E say na di list of tings wey I go buy for am to take celebrate di birthday.

E say e go come back today3 o’clock pm in di afternoon to collect money for di birthday list and di money to go book wia me and im go dey togeder TDB.

As Siki Babe waka comot for garage, up till now wey I dey nack una dis tori so, I confuse.

Abeg, how I go take handle dis matter before e too late?

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.



Comments

Post Comment

Wednesday, October 15, 2025 5:09 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025