2023 go hear nwi for Naija people hand

News Express |21st Aug 2020 | 1,500
2023 go hear nwi for Naija people hand

Everyting for dis world get im own time. Wetin people dey hala today, tomorrow you fit no hear am for anybody mouth again.

E jus be like dat time wey Oga Abacha dey use black igo take cover im eye patapata for morning, afternoon and night.

Dat time, na so so Vision 2020 person go dey hear for di oga mouth. Small time na Vision 2020 everybody for Naija come dey talk.

If you watch TV, na Vision 2020. You say make you tune Radio small, na Vision 2020. For Newspaper nko? Na di same Vision 2020 you go see.

Sote, Vision 2020 even enter market, school, church and mosque. Tori Olorun!

Dat time, any passenger wey I carry for my guonguoro, na Vision 2020 dem go dey talk. I confuse.

One day na im two bobo like dat wey I carry for drop begin dey talk about Vision 2020. Dem argue sote dem wan begin exchange blow for inside my guonguoro as we dey go for Oshodi/Mile 2 Expressway.

I come ask dem wetin be dis Vision 2020 sef wey everybody jus dey hala.

Na dat time I come sabi say Vision 2020 na magic year. E mean say, na dat year gofment go make milk and honey begin flow for Naija. Di year wey water, light, food, house, money, everyting go dey yanfu yanfu.

Na dat 2020 we dey inside so o. I no know weda anybody see any mikl and honey. Abi my eye dey pain me?

Di only ting I know be say, dat Oga patapata even dough e don peme tey tey, any day Naija broke small, e go jus vomit plenty money make gofment take do wetin e wan do.

Na now I come understand dat Vision 2020 well well.

Now, na 2023 everybody dey hala. For TV, Radio, Newspaper, market, church, mosque - na 2023 you go dey hear.

E come be like say everybody for Naija don lay ambush to waylay 2023 wey no even near sef.

I sure say anywia 2023 dey now, im ear go don dey pain am gan becos of di kind way everybody for Naija jus dey hala am.

2023 go don dey fear sef weda e no go hear nwi for Naija people hand wen e finally land.

Na only Eledumare go save 2023 for Naija people hand.

Helep me say Amin!

Make we jam again on Tuesday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.



Comments

Post Comment

Wednesday, October 15, 2025 5:14 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025