My papa poor well well, for 18 years I no get shoe — Adeboye

Posted by News Express | 25 December 2022 | 376 times

Gmail icon

•Pastor Adeboye

 

Na NELSON DAFE dey nack dis tori

Di oga patapata of Redeemed Christian Church of God (RCCG), Pastor Enock Adeboye, yan on Sunday how he come from very poor family.

For di Christmas message wey he give him church pipul Adeboye say when he dey grow up he parents poor well well and for di fest 18 years of him life he no get shoe kaka.

Adeboye yan on Saturday for di preaching when he call ‘Perfect Gift’ wey dey show live for him Facebook page.

He come use himsef give exampul of how things go beta for pipul wey accept Jesus Christ.

“Those of una wey know small how I take grow, una go know say wey dem say something hard well well for me, he really hard. E hard no be small. My papa poor ehn, sotey even poor pipul dey call am poor man. Di day wey he buy umbrella ehn, we begin celebrate,” na so Adeboye yan.

“Our elders say if papa and mama poor e go affect dia children. E affect me. For di fest 18 years of my life I no get shoe. Na so things be until I come know Jesus. Everything come change. Now see me today na,” na so Adeboye still yan.

He come still add say: “Way back for 1969 I be lecturer for UNILAG. One small problem come come wey mathmatics pipul no fit solve. Somebody come show me Jesus and I thank God say my head no refuse beta thing. I accept Jesus and everything come dey beta for me.”


Source: News Express

Readers Comments

0 comment(s)

No comments yet. Be the first to post comment.


You may also like...