Posted by News Express | 22 December 2022 | 183 times
Na NELSON DAFE dey nack dis tori
Foma Super Eagles coach Samson Siasia say e beta as Ghana beat Nigeria and stop dem make dem no go di Qatar 2022 world cup wey just end so.
Siasia wey believe say dem for just dey beat Naija any how for di world cup.
“Dem for too beat us for di world cup. Na shame we for take comot. We no suppose go di world cup and to lose to Ghana for di qwolifaia show say we no suppose go,” na so he yan.
Siasia coach Nigeria for 51 matches and im team score 13 goals.
Super Eagles goalkeeper John Noble no agree with Siasia sha. Noble say Nigeria for reach semifinal if to say dem qwolifai.
“If to say Naija qwolifaiehn,na different thing e for be. Di players been ready to give dia best especially those wans wey neva go world cup before,” na so Noble yan.
Super Eagles next match na March 20 against Guinea Bissau for Abuja. Di match na to qwolifai for di 2023 Africa Nations Cup.
0 comment(s)
No comments yet. Be the first to post comment.