Posted by News Express | 28 November 2022 | 237 times
Na NELSON DAFE dey nack dis tori
Tori wey come say one Nigeria student Aminu Mohammed wey be 500 levul student of Fedral univasiti,Dutse don land for police hand becos of alegeshion wey he make agaisnt First Lady Aisha Buhari.
Dem say Mohammed yan for Twitter say Aisha Buhari don thief Nigeria money baleful. Na Hausa language he take tweet am.
Polife tori person Muyiwa Adejobi neva tok put for di tori of di arest of Mohammed.
E be like say Mohammed neva fit reach him family sef.
E neva tey wey Aisha Buhari beg Niaja pipul say make dem no vex say pipul for govment neva do enof to help Nigerians.
“Pipul been expect a lot from us and maybe afta 7 years now we neva fit satisfai dem. Na only God know wetin dey person mind,” na so Aisha Buhari yan.
0 comment(s)
No comments yet. Be the first to post comment.