Posted by News Express | 21 November 2022 | 340 times
Na NELSON DAFE dey nack dis tori
One final year student of Federal Polytechnic Oko don commit suicide.
Di guy kpai himsef on Friday becose say him babe leave am.
Tori wey come be say di guyman drink sniper becose him girlfiend tell am say make he luk for anoda girl.
Dem say di guy be don olredi dey do him IT before wey be work wey student dey work near when dem wan graduate.
One student Iyke Oji say di guy wey kill himsef so,say na guy wey dey ginger well well before.
“He been dey do him IT o. He decide to stay for Okho for di IT so. But insted of to focus on am he come dey focus on love,” na so Oji yan.
Tori pipul been dey call di tori man of di skul Chijioke Ibeziakor but he no ansa.
Police tori man for dat side Tochukwu Ikenga no still ansa him call too.
0 comment(s)
No comments yet. Be the first to post comment.