Posted by News Express | 19 November 2022 | 236 times
Na NELSON DAFE dey nack dis tori
One woman wey be dey 99 years, wey pipul believe say na she be di oldest primary skull student wey dey dis world,don die for Kenya. Na so her grandson yan.
Priscilla Sitienei start to sick on Wednesday afta she go class come.
She been dey redi for exam with her classmate dem wey be say na 12 years dem dey.
Ms Sitiniei story make United Nations film and culture pipul Unesco do movie abaut her and come still praise her too.
Na when Britain dey rule Kenya na e she grow and she see as her countri strogul to get independence from Britain.
She tell UNESCO last year say she wan motivate young modas dem.make dem go back to skull.
“I wan show dem and oda girls wey dey dis world say if you no go skull,difrens no dey between you and ckikin,” na so Sitinei yan.
She enta Leaders Vision Preparatory School for 2010, but she sarv her village of Ndalat too as midwife for more than 65 years. She evun help deliva some of her classmate dem sef.
Any pikin wey she she wey no dey go skull she go ask am why.
“Dem go say I don tu old to go skull. But I go tell dem say me dey skull so you no tu old to go skul,” na so Setenei yan.
At fest dem.be no gree make she enta skull but wey dem see say she serios abaut education dem come leave am make she enta.
Dem tell her stori for one French film Gogo and she come use dis levul enta France and visit France fest Lady Brigitte Macron.
One person wey join rite di film Patrick Pessie come praise Setenei for Twitter. “Di message wey she give abaut education for girls still dey gidigba.”
0 comment(s)
No comments yet. Be the first to post comment.