Chelsea coach Porter say he no get wetin he wan tok sorry for,as Brighton fans boo am wen dem seat Chelsea

Posted by News Express | 30 October 2022 | 288 times

Gmail icon

•Graham Porter

 

Na NELSON DAFE dey nack dis tori

Chelsea coach Graham Porter say he no dey tell Brighton fans sorry for di way wey he take leave dem go Chelsea. Na so he yan afta Brighton fans show am pepper, come dey boo am am when Brighten play Chelsea for premier league on Saturday wey dem play for Brighton house.

Brighton give Chelsea wotowoto, as dem win 4-1.

Porter coach Brighton when dey finish 9 for league last season, and na di highest wey dem don finish for league be dat. He come comot go Chelsea afta 6 matches dis season.

Di fans boo Porter (wey be 52 years) no be small during di match. As first half dey end 3-0, Dem begin sing: “Porter,Porter wetin be scores?”

Dem come ask am say how he see di vex wey di Brighton fans dey vex for am, Porter come yan say: “Na dem get dia mouth. I do well for Brighton and I keep di club well before I comot.”

Porter say di fans really help Brighton o, and say di result pain am.


Source: News Express

Readers Comments

0 comment(s)

No comments yet. Be the first to post comment.


You may also like...