Posted by News Express | 3 December 2021 | 818 times
Since Wednesday wen dis December month show face, my torch light chinko phone don hear nwi. Now na so, so charge I dey charge di battery.
Me sef, headache don dey hammer me becos of orisirisi calls.
I no know weda or wedan't all Lagos sisi dem tink say 25th na my birthday. Dem no let me rest again.
All of dem wan make I give dem sometin for keresimasi.
Since dis month, any time wey Iya Bukola wey dey sell paraga and monkey tail for our garage see me, e go say, "Oga MAT make you no forget me dis keresimasi o. I dey expect sometin from you o."
Jumoke wey dey come sell hot agbo for our garage tell me di order day say, even as I no dey follow am buy market like Mutiu dem, dis keresimasi I must to give am sometin.
Aisha own na im be worss. Aisha, di mobile buka girl wey dey carry Ewa Agonyi for head come sell, siddon wait for me yesterday ti-ti-ti-ti for our garage wey dey near Ikeja under bridge.
I carry passenger go drop for Owode after Sango Ota. Una kukuma sabi as dat place far. We comot by 8 O'clock a.m in di morning, before I come back evening don come.
I surprise wen Aisha tell me say e don dey wait for me since morning. I ask am hope no troublem, e say e come collect im keresimasi gift. I say shiioorr, na im make e no go sell im market, come dey wait for me since morning?
Aisha say make I forgot dat one, e say since last year wen I tell am say I like am, sote Sikiratu come fight am for our garage, wetin I don give am?
I ask am how e go jus waka come like dat, e no even tell me? I tell am say I no get money for pocket now. Aisha say make we go POS. I tell am say I no dey use POS becos I hear say dem dey play kakokalo with person card.
E say ok, make we go ATM. I tell am say I no bring my ATM card come garage today.
E say sebi I carry passenger go drop for Owode, weda di passenger no pay me money.
I ask am how e take know say I go Owode. Aisha say make I forgot dat one. I shock. I come talk am for my mind say, so dis mobile buka girl na monitoring spirit!
I tell am say sebi keresimasi still far nah, make e come back anoder day.
Aisha say e no fit come back, say e wan travel go im village for Kogi go do odun till after new year. E say na im make e siddon wait for me from morning till evening. E say if I no get money for pocket, make I borrow for my union member hand. Tori Olorun!
Na so I take style give Aisha di 10k wey my passenger pay me o.
Sikiratu keresimasi and new year long list dey one corner. Olorun Oba o!
Even if 25th na my own birthday, shey dem no fit contribute money give me like people do for OBO last month?
Na im make I don decide say, from next week, I go off my phone. Na im be say I no dey, I don travel.
Make we jam again on Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
0 comment(s)
No comments yet. Be the first to post comment.