Shey, dis one na New Year jolly jolly?

Posted by News Express | 3 January 2021 | 1,334 times

Gmail icon


Some tings dey for Lagos o! Some people go dey wound demsef, dem go tink say dem dey enjoy until dem kpeme.

I jus say make I put my guonguoro for road dat Friday wey be New Year day as I don siddon dey play with my family from morning till 1 o'clock pm in di afternoon.

I drive from our area wey be Abule Egba, pass Oko Oba, to Pen Cinema, den begin go Moshalasi Alhaja. Nobody stop to say make I carry am for road. I come talk am for my mind say na wa o. Na so dis our contry don bad reach?

Di ting be say, people no even dey for road like tele-tele wey passenger go full everywia for new year. All of dem go drag you at di same time. Dem go nearly tear your clothe say make you go drop dem for Apapa Amusement Park or National Theatre or Tafawa Balewa Square etc, etc.

Dis time, nobody go anywia. Dem say dem no get money to chop, wetin dem wan go do for outside?

Na so I dey burn petrol dey go, no passenger. Na im I say make I drive dey go, so dat I branch our garage wey dey near Ikeja under bridge, weda I go see any of our union member dem.

As I jus pass dat Mobil petrol station small for dat junction wey dey branch go Ogba, say make I pass Guinness dey go Ikeja, na im one alakoba Okada man chuk head put under my guonguoro, on motion o. Tori Olorun!

Kia kia, I match break fiiiaamm! I open door run to go see di person. Na so di bobo jus lie down for dia, im okada don go fall for gutter, but di engine still dey on.

Four workers dem for dat Mobil petrol station wey sabi me as dia customer run come meet me.

Na so di five both of us try to bring dis bobo comot for under my guonguoro, no wia.

Di next ting be say, di bobo jus manage talk say we dey disturb im sleep for inside im bedroom. Na as e open mouth talk, everywia come smell like say di bobo take ogogoro baf. Olorun Oba o!

I enter my guonguoro, use style and revise back small, na im space come dey make we fit carry dis okada man up o. Anoder person go off di okada engine for inside gutter, bring key come give am.

Di bobo open eye small. As e see five of us, e ask us wetin we dey do, weda we wan rob am.

Di bobo trowey im okada key for gutter, lie down for road again, and begin sleep dey go.

I tank di four Mobil petrol station worker dem wey run come helep me. I tell dem make dem go back go do dia work.

I jump inside my guonguoro and took off. Tank Eledumare say di okada man no wound, and e no spoil my guonguoro.

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Happy New Year, my people.

 


Source: News Express

Readers Comments

0 comment(s)

No comments yet. Be the first to post comment.


You may also like...