Posted by News Express | 28 December 2020 | 996 times
Oga patapata of INRI Evangelical Spiritual Church Lagos, Primate Babatunde Elijah Ayodele, don tell Naija piple to pray plenti plenti as God don tellam plenti bad tins wen go shele for 2021.
Eem say for eem vision next year go betta pas 2020, but Naija need to pray against ruf and tuf time bifor September.
Akordin to Ayodele, Naija ekonomi and Muhammadu Buhari gofernment go dey shake as kabal and terrorists go won take ova. Eem say Buhari go konfuse as Kovid-19 wahala go still dey.
Di Ogbonge seer when predit win for Godwin Obaseki, Rotimi Akeredolu and Joe Biden for elections for Edo, Ondo and United Stets of Amerika say PDP go kpake Okigwe Zone elecshion.
Hear Primate Ayodele: “Forget about zoning in APC or PDP. Okigwe zone na PDP getam unless dem rigam. Gofernor Hope Uzodinma of Imo need take time as Suprim Kourt fit remove am if eem nor manage eem case well.”
Eeh deklarate say North go win kooly again for 2023 as Igbo presidency no go work “bikos of konfusion and katakata amond dem dem”.
Primate Ayodele say “Naija need to do tru federalism to prevent break up and na why wi need plenti prayers.”
Di Ogbonge INRI oga say God tell am say Bola Tinubu go crash for drim to bi Naija president bikos of one problem. Eeh also say Tambuwal, Amaechi and Saraki go fall by di wayside.
Eeh yan say insurgency and kidnap katakata go still dey next year bikos of karaktar of some Buhari big men wen turn am to big business. To eem na only God fit save Naija.
“I dey see kidnap of kids and kpaiing or killing of yung piple. Make wi pray against bird flu wen go kpai many fowls. One gofernor go manage escape assassination when bandits attak eem moto. Big atak for Abuja plus churches, leaders and politika assassinate.
“Afrika go lose very important person as plane/helicopter, train and oil vessel accidents go happen with plenti killings. So will need plenti plenti prayers.”
0 comment(s)
No comments yet. Be the first to post comment.