Posted by News Express | 14 August 2020 | 1,396 times
Yesterday, market bad no be small. Na so I blow my guonguoro come from our house for Abule Egba, reach our garage wey dey near Ikeja under bridge, no passenger stop me for road.
I never see dat kind ting since I begin do dis my taxi driver work for Lagos.
Wen I reach garage, all our union member dem don comot. All of dem carry passenger for charter, na only me remain for garage dat morning.
As I siddon dia, na so so tink I dey tink. If no be say dat wicked Arike Papa don peme for my village, I for talk say na im still pursue me reach Lagos.
Una kukuma sabi say na becos of Arike Papa I run comot for my village for Ogbomoso, come Lagos.
Di man say na me give im pikin Arike belle, jus becos me and Arike dey siddon for di same table for Standard 5 for di night school wey dey our village dat time.
But I sabi say no be me do am. Na only be say my body and Arike body dey touch as we dey siddon togeder for class. Shey dat one reach to give person belle? But dat wicked man say na me give im pikin belle, sote e wan take African Insurance finish me.
But dat yesterday as I siddon dey tink for garage, I remember say Arike Papa don peme tipe tipe, so now who come be my enemy wey no let me see passenger carry?
Na di ting I dey tink wen one bobo waka enter our garage dat morning. As I jus see di bobo, my belle come sweet becos I know say correct passenger don land be dat.
Di bobo say e wan take taxi for charter. I tell am say I ready. But e say di place wey I go carry am go na outside Lagos. I tell am say no troublem at all. I say even if e wan make I carry am go drop for moon, no wahala. After all, my work na to drive passenger, but na money kill am.
Di bobo ask me di condition of my guonguoro, I tell am say I jus service am last week, say di only ting be say no AC. Di bobo say imsef no need AC as e be say di weather cold well well.
E ask me how much I go take for charter, I tell am say e depend on di place I dey carry am go gan gan.
Di bobo come talk say I go carry am tomorrow morning, say e wan go see with im two korokoro eye wetin dey happen for im village. E say I go jus go drop am, sleep and come back di next day.
I ask am wia im village dey. Di bobo say im village dey for Southern Kaduna. Olorun Oba o!
Me, carry you go Southern Kaduna and even sleep for dia?
I tell di bobo say I don dey beg Eledumare since morning make e show me my enemy.
I bring out my chinko torch light phone, I tell di bobo say if e no disappear one time, I go call and tell olopa for Area F say I don catch my enemy.
No be person tell di bobo make e vamus kia kia.
Abeg, instead make I go make person cut my head comot, make I siddon wia I dey so. Passenger go come. After all, everyday no be Xmas.
Southern Kaduna ko, Western Katsina ni.
Make we jam again on Tuesday.
Tank you.
Tank you very much.
And tank you very, very much indeed.
0 comment(s)
No comments yet. Be the first to post comment.